The Nigerian Police

This is the Nigerian Police as we interact on a day-to-day basis in my area:

Police: Hey boy ! identify your self?

Boy : well i’m Ibrahim and i am a UNILAG student

Police: Wey your I.D Card?

Boy: I be fresher naw dem neva give us

Police: Fresh wetin? #edondeymadt abi?

Boy: I just start

Police: So you don press laptop chop oyinbo money finish now u dey lie say na student you be.

Boy: Oga no be so ooo

Police: Wetin dey inside your bag?

Boy: Na my laptop and books

Police: Where you see money buy laptop and this your watch and chain sef?

Boy: Na my mama buy am o..

Police2: Shuo! no be this boy dem dey call arabmoney for shomolu?

Police; Arab what?!!? Good, you are under arrest !

Boy: why na? Police : for prohibition !

Boy : ‘WHAT’ ? Police ; you exhibit too much swaggz plus you be yahoo boy

Boy: Oga no be so naw

Police: c’mon sharrap and enter motor!

Boy : *laughs* oga I understand you,oya manage this N2000

Police: Add something jor..na my oga*DPO* dey motor so and him go take him share

Boy: O.C I swear na N500 extra i get here..i be your boy naw we dey area.

Police: You these yahoo boys ehn…una no dey like show for station come greet us

Boy: No vex my oga just manage this N2,500

Police : you get mouth !..I go dey expect you o!

Boy: No wahala Oga mi #OKbye

Morals: The Police is your friend. Just settle dem. 🙂

Phone Sex
To Smash Or NOT To Smash(Laptop)

13 COMMENTS

  1. Thanks for thiS… Now I know how to deal wid d popo. Na to dey kip dere own pocket money inside glove compartment from now on.

What Do You Think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.